Di Ghana Refugee Board (GRB) don confam say at least 186 Ivorians bin enta di kontri for di last two weeks.
According to di board, di Ivorian nationals say dem bin dey run away from political tension ahead of dia kontri presidential election wey go happun for October 2025.
Di president Alassane Ouattara bin announce say im go seek fourth term chance for office afta im don change di constitution for 2016 to remove presidential term limits.
Early last month, thousands of pipo bin hit di streets to demonstrate say dem bin comot opposition leaders from di upcoming elections.
Dem bin ban di leading opposition leader from di elections sake of dem say im still be French citizen at di time im declare to run for elections even though later im don renounce im French nationality.
Ivorian law no dey allow pipo wit dual nationality to run for president.
Elections for di kontri bin dey happun wit violence and tension.
Na so some Ivorians begin dey run away to find refuge bifor tins go scata.
Executive secretary for di Ghana Refugee Board Tetteh Padi tell BBC News Pidgin say “so far we get 186 pipo wey don enta di kontri for asylum, most of dem na women and children”.
Im add say “dem tell us say di tension bin dey build up for dia dat be why dem begin to find refuge bifor e go dey late”.
Di refugees currently dey for di Ampain Refugee Camp for di Ellembelle District of di Western Region.
BBC News Pidgin don ask if di kontri get di capacity to accommodate and handle more refugees if dem continue to dey enta di kontri, dis na wetin oga for di refugee board tok: “We get wetin we call inter-agency group wey include govment agencies, UN agencies and oda international NGOs wey we get contingency plan we go activate if di numbers don rise.”
Oga Tetteh Padi explain di process dis pipo bin dey go through bifor dem enta di camp.
“Wen dem come in, we bin dey screen dem; security and health screening. Afta dis, we don dey capture dia biodata to positively identify dem bifor we admit dem,” oga Tetteh Padi tok.
Ghana bin dey share border to di west wit Ivory Coast.
Communities like Elubo, Half Assini, Sampa and Debiso for di Western and di Bono Ahafo Region.
Oda settlements like Buanfo, Gbenshe, Babianiha, Amutinkrom all bin dey along di kontri border wit Ivory Coast.

Wetin we know about di Ampain Refugee Camp
Dem bin establish dis camp on 19 March 2011, for di Ellembelle District of di Western region of Ghana.
Dis na di first of three camps wey bin dey set up for 2011 to shelter displaced Ivorians wey bin dey run from tension from di November 2010 presidential election for Ivory Coast.
As at 2017, di camp bin get 3,442 “pipo of concern”.
Dis na pipo wey be Ivorians wit only 1% wey be from oda kontris wey bin dey Ivory Coast at di time of di crisis.
Di Ghana govment bin dey provide assistance for dis camp through di National Disaster Management Organisation (Nadmo), wia di Ghana refugee board get oversight of dia operations.
Di UN Refugee agency bin dey continue to collaborate wit di immigration service, police, local assemblies and di Ghana Health Service to run dis camp and di oda camps.